expr:class='"loading" + data:blog.mobileClass'>

best in vlogging top news, entertainments, videos, sports, jokes, celebrity news, music :)


Monday, April 21, 2014

A MUS READ... OPEN LETTER TO PRESIDENT JONATHAN...(Written in PIDGIN)


Dear Mr. President, I just want beg you Bros
Jonathan. I take all the gods of Nigeria beg
you. I take all the gods wey people dey hide
worship beg you. I take the God wey most of
us dey worship openly beg you.


I take the day wey dem born you take beg you. I take all the things wey you like beg you. Bros, as I dey write this ehn, na prostrate I prostrate for you oh. I take all my heart beg you. I take my papa yam farm beg you. I use my papa cocoa plantation beg you.
I take Anti Party take beg you. Shey na
2015? No worry we go dash you till 2019.
Missing $20 billion? No be craze de worry
Sanusi Lamido, where him see that kind
money dey miss, no mind am Bros, we don
comot our mind for that one too. We no even
want know how you take dey spend oil subsidy money Bros. Spend am anyhow, na
you be Presido.
Even the one trillion naira for security sef, we don close our eyes.
Bros, if you like no do any road again, we no
go ask you.
Fuel scarcity?? No worry Bros, e don tey wey we don dey use to am.
We sabi buy black market. Abi people wey
dey sell am dey from there get dem own
chop no be we brothers?
Bros, even jobs sef, no worry your head for that one. Na you send people make dem born plenty children? No worry, we sabi struggle.
Electricity? Forget dat one Bros J. How many of we grand papas use electricity? Dem no live long? We go dey manage dat one too. If we want enjoy, we go use our Generators. Thank God say we never follow your advice say make we throw dem away.
Bros J., all these my begging ehn, na
one thing I need from you.
This one wey Nigerians life no come even get
value reach cockroach for oyinbo land own
tire me. Bros, just use all your head and mind
dey see how you go take dey protect our life.
We no need all those things wey we dey
disturb you for. Na long throat dey do us.
Just help us make we dey safe Bros. If you fit
do that one for us ehn, I go join curse
anybody wey ask you how you take dey
spend we money. We no want to dey waka
dey fear say the next sound fit be bomb
sound Bros.
We no want to dey see fellow struggling
Nigerians dey roast like chickens wey oyinbo
say dem get bird flu. Bros J, sebi you talk say
you no get shoe? E mean say you too be one
of us before before. If dem former leaders no
protect you allow bomb finish you, se you for
reach where you dey so so tey you no fit
know how many shoes you get.
God wey carry you reach there never resign oh and na Him I dey take beg you make you do everything to see say we too live oh. I beg
Bros J., no mind all these people wey say you
no go continue.
Just protect our life for us. Na your hand
soldiers, police and all of them dey. Use them
protect we the poor masses too na. No be
only the big big men and women deserve to
live safe. We too, na life dey our body and
wetin fit make wey una dey where una dey
so, we too fit reach there oh one day.
But, that one na only if we live. I take God beg you Bros J., na beg I dey beg, no be strong head.
Greet mama peace,abi wetin dem call am,for
me!
..... Happy easter o!

No comments:

Facebook Blogger Plugin: Bloggerized by Inspirational Online Enhanced by Abbasi Zaibi

Post a Comment

Disclaimer: Comments on this blog are not posted by the Blog owner,therefore, the blog owner will not be liable for any comments made by readers.Thank you.

If you need to contact AY
News/Tip Off/Advert ETC
Mobile Phone +393888043906
Email cast101aysblog@gmail.com
BB Pin 7516F9AF


#bringbackourgirls

HILARIOUS: Conversation Between The First Lady And The President After The Breakdown On National TV

Check Out Photo Of Girl Who Slept With Her Boyfriend's Best Friend In Warri